EDC Pages

Transforming Nigerian Youths AWARD Terms and Conditions – Pidgin

Overview #


As person wey dey learn on top Transforming Nigerian Youths Program, we no just dey only interested to sama you wit beta informate wey go helep your business but we also wan support
your business wit brekete awoof. Dis ogbonge awoof nah to ginger you make you fit complete dis our program so. Di awoof dem go com for di different different stages wey dey inside di program.

Some of this ogbonge awoof nah:


● GoogleMyBusiness Registration
● Website Development
● Instagram Booster Package
● 30mins Business + IT Consultation Session
● Logo Design


These awoofs na for FREE and you fit get am for different stages as you dey learn.

Terms and Conditions #


Performance Award Metrics: Evri week, make you for show say you dey do well as you dey learn way go make you collect one of the awoof, you suppose do all these things below:


Course Completion: Make sure say you finish at least 4 courses evri week. Dat mean say you don watch di videos and you don also take di test.


● Good Quiz Performance: You suppose score at least 50% for all di tests wey you go take.

● Timing: If you dey among di first first pipu wey don do the above things, you go get di awoof wey follow for dat levu

Performance Award Stages: #


Sake of say make you fit use dis chance wella, we don cut cut di program into plenti stages so you go fit use your time and chance well well.

You qualify to collect award for any of di stages dem so long say you meet the performance metrics wey dey on top.

Di different stages and awoof dem dey below:


Stage 1: Dey among di first 150 pipu wey meet the performance metrics wey dey on top for di first week make you for win GoogleMyBusiness Setup.


Stage 2: Dey among di first 30 pipu wey meet the performance metrics wey dey on top for di second week make you for win Instagram Booster Package.


NB: Second week nah any other week wey you take finish four courses AFTER the first week.


Stage 3: Dey among di first 20 pipu wey meet the performance metrics wey dey on top for di third week make you for win Logo Design.


NB: Third week nah any other week wey you take finish four courses AFTER the second week.

Stage 4: Dey among di first 15 pipu wey meet the performance metrics wey dey on top for di fourth week make you for win Business + IT Consultation Session.


NB: Fourth week nah any other week wey you take finish four courses AFTER the third week.


Stage 5: Dey among di first 5 pipu wey go finish all 18 courses con submit your Growth Plan for di fifth week make you for win a Website Design.


NB: Fifth week nah any other week you take finish the courses wey remain AND you come complete your Growth Plan on top AFTER the fourth week.

Please e go beta make you sabi say nah awa system go automatically select pipu wey qualify evri week as we take put am for di Terms and Conditions. We go dey announce di winners evri week



WE WISH UNA WELL!!!!